“Nigerian schools resumption” date latest update from federal, state owned universities across di kontri

Many private Nigerian universities don ready for face to face classes afta di Covid-19 pandemic but dem want di goment to dey specific enough by issue dem notice alias memo to reopen dia schools to students on a particular date, BBC Pidgin don find out. 

Now what about di goment owned federal and states universities? Wetin go happun next for dem ontop dis Nigerian schools resumption announcement?

Unlike di announcement wey close down all schools across di kontri for March 2020 sake of coronavirus, di Nigerian goment announcement of 3 September leave di decision to resume for school administrators and state goment hands.

About 44 Federal Universities and 48 States Universities na im dey Nigeria according to di National Universities Commission. 

Many of dem bin close down since March 2020 wen di Federal Ministry of Education bin shut down all schools sake of di coronavirus outbreak.

Tori be say, currently di Academic Staff Union of Universities warn goment say make dem no reason to reopen tertiary institutions if dem no take ogbonge steps to stop di spread of Covid- 19.

Di union argue say to maintain social distancing and oda Covid- 19 protocols no go dey possible for di kontri tertiary institutions as dem too dey crowded already.

Although some private tertiary institutions say dem don dey ready to resume but dem dey wait for specific date from di goment before dem open, some goment owned tertiary institutions also don show green light say dem ready for resume as.

 Click here to save this Post as PDF
Let us connect on social media forever;
Keep in touc

Somtochukwublogng

Serving news and stories to the people of the Federal Republic of Nigeria.

Contents created by Taiwo Hammed.
Avatar
Keep in touc

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *