Edo Commissioner for Mineral resign from Obaseki camp just 10 days to 19 Sept. Governorship election

Edo State Commissioner for Minerals, Oil, and Gas Joseph Ikpea don resign.

Oga Ikpea resignation dey come 10 days to di Edo state governorship election, according to local tori.. 

For inside letter wey im write give di govnor on 9 September, he explain say reason why im wan resign dey based on trust, respect and say im no fit leave di APC as im don help build di party from scratch.

He say “politics na all about interest, trust and respect for one another but I neva get any of dis things till dis date and I no sure say I go get am even if I dey there till tomorrow.”

“Na me bring di party wey dem sabi as APC today come Esan South East and more than 90 percent of my supporters still be members of APC.”

“E dey hard for me o live di house wey I build and even di current administration no notice my leadership role.”

Di former commissioner don promise to support di candidate of di All Progressives Congress, Pastor Osagie Ize-Iyamu.

Ikpea go make am di third commissioner for govnor Godwin Obaseki cabinet to resign dia position go support Ize-Iyamu.

 Click here to save this Post as PDF
Let us connect on social media forever;
Keep in touc

Somtochukwublogng

Serving news and stories to the people of the Federal Republic of Nigeria.

Contents created by Taiwo Hammed.
Avatar
Keep in touc

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *