Gana Benue State: Terwase Akwaza disturb north-central Nigeria, turn “Most Wanted Criminal” before sojas kill am

Terwase Akwaza alias “Gana,” di most wanted man for Benue State north central Nigeria wey di kontri army confam say dem kill on Tuesday, first enta public eye for 2015 wen di Benue state goment grant am and 500 pipo amnesty. 

Tori on wen or how Gana take begin im jaguda work or wetin make am turn criminal start no dey, but BBC Pidgin find out say e start as come armed robber attack for Katsina-Ala area of LGA of Benue state.

E come enta a public eye wen di Benue State govnor, Samuel Ortom blow whistle on say e dey terrorize di state and dey cause security problem for pipo of di state. 

Afta dem no fit catch am, di goment grant am forgiveness alias amnesty but dem claim say e go back to di work as crime continue to dey disturb di state.

Gana na di most wanted jaguda pesin for Benue state as im and im gang don carry out dia deadly criminal operations around Sankera area wey include Ukum, Logo, and Katsina Ala local goment of Benue state.

Dem even spread dia evil deed enta Taraba state. Dem dey cari out high profile robbery and kidnap pipo for ransom and even kill pipo. Dem also dey relate wit herdsmen to commit crimes.

Im and im gang dey accused say dem kill several innocent pipo including di special assistant to govnor Ortom on security according to authorities and sake of dis and oda crimes, security agencies don dey look for am tey-tey.

Gana na indigene of Gbise for Katsina-Ala LGA of Benue state. He dey speak Tiv, Idoma and Pidgin English. 

2015 Amnesty

For 2015, Benue State govnor for im first tenure bin grant amnesty to 500 suspected criminals including Gana and im boys wey dey always terrorize im state. 

Dem dey go formalize di second leg of di amnesty programme wen military block dia convoy along Gbese-Gboko-Makurdi kill am.

2016

Di Benue State police command for 2016 claim say Gana and im gang kill five pipo for di state including one 85 year old woman wey dem shoot dead as dem attack Tor Donga in Katsina-Ala Local Government Area of Benue State.

Police declare am wanted for 2017

For 2017, di Nigeria Police Force declare am wanted as dem put 10 million naira bounty for im head, wey dem go give anybody wey sabi wia im dey hide or get any useful informate about am.

Police accuse Gana say e kill 17 pipo for Zaki Biam and 50 others for different locations for Benue state. Dem also say na im dey responsible for di death of Desen Igbana, di Special Adviser on Security to Benue state govnor, Samuel Ortom.

Dem say he break di amnesty programme as e return to im crimes. Dem claim say na im and im gang dey responsible for di Kidnappings, armed robbery, cattle rustling, and assassinations wey continue to dey happun for di state.

2020 Second Amnesty

Di Benue state goment bin declare second amnesty and call on jaguda boys dem for sankera geo-political region of di state make dem surrender dia weapon.

Gana and members of im gang members bin dey go Makurdi to formalise dia second Amnesty programme wit di state goment before dem kill am.

 Click here to save this Post as PDF
Let us connect on social media forever;
Keep in touc

Somtochukwublogng

Serving news and stories to the people of the Federal Republic of Nigeria.

Contents created by Taiwo Hammed.
Avatar
Keep in touc

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *