Garba Shehu “Tweeter N600 fuel price history” of Buhari vs PDP goment don cause social media gbas-gbos

Malam Garba Shehu, Nigerian President Muhammadu Buhari tok-tok pesin don cause gbege on top social media ova di increase in oil prices.

Di tori start wen oga Garba post di tori say dem bin dey sell liter of fuel for 600 Naira for 2013.

Dis dey comot from di tok-tok of di recent hike in di price of fuel from 138 Naira to 151 -162 Naira.

Federal goment bin tok say dis price hike na sake of say dem don comot subsidy and no go dey control price of fuel again.

Di tweet get a lot of backlash as pipo accuse oga Garba say goment dey like to dey compare demselves to past administrations wen pipo dey complain.

One of those wey comment, point out say di same 600 Naira wey im dey accuse di past administration of, na im some Nigerians buy fuel for December 2017 and November 2019.

Tori wey dey comot be say be say for November of 2019 goment bin tok say di price of fuel bin dey high for areas wey near di Nigerian border.

Dis tori dem comot from border towns for Sokoto, Katsina, Ogun, Lagos and Adamawa afta Buhari bin order di ban of selling fuel for border towns wey dey closer than 20 kilometres from di actual kontri border.

How petrol pump price don increase under Buhari

  • May 2016, di price of petrol later increase from N87 to N145 per litre, di Minister of State for Petroleum, Mr. Ibe Kachikwu say di increase dey come to balance di different prices wey Nigerians dey pay to buy fuel from di marketers sake of fuel scarcity.
  • March 2020 – Sake of di crash in crude oil prices for di international market, pump price of Premium Motor Spirit (PMS) move from N145 to about N125 per liter.
  • Afta one month, for di second time in May 2020, di Petroleum Products Pricing Regulatory Agency (PPPRA) don announce new pump price band to between N121.50 to N123.50 per litre for petrol.

Wetin pipo dey tok on top Fuel Price reduction

Nigeria na one of di biggest producer of petroleum product but from di reasons wey goment dey give for di reduction and most times increase in di pump price of petroleum products, e dey obvious say di global crude oil price play ogbonge role for di stability of petrol pump price for di kontri.

“Afta we don review how di prevailing market be for di month of June and as we dey consider di moni wey marketers’ dey use buy di products , we wish to advise new PMS pump price band of N140.80 – N143.80 per litre for the month of July 2020,” Nigeria Petroleum Products Pricing Regulatory Agency statement tok on Wednesday 1 July, 2020.

Di statement advise all marketers to operate within di price wey di PPPRA advise.

On Wednesday, September 2, 2020, Nigerian Private Owners Association (IPMAN) direct dia members to increase price of petrol to N162 per liter.

Di increase follows announcement by Nigerian authorities of an increase of N151.56k.

How di next increase of petrol pump price go be for Nigerians

Nigeria goment no go dey control di price of Premium Motor Spirit wey pipo sabi as petrol and dem no go dey determine di price wey filling stations wan sell fuel again.

Goment through di Petroleum Products Pricing Regulatory Agency tok dis one as dem dey brief tori pipo for Abuja. 

Di agency join say goment don comot hand patapata for di downstream arm of di oil and gas sector.

Executive Secretary for di agency Abdulkadir Saidu, add join say from now henceforth, na market go dey dey determine di price of petrol and di international cost of crude oil.

He say wetin di agency go dey do na to make sure oil marketers no take advantage of di situation to cunny pipo, as di marketers go dey free to buy petroleum products anywhere dem like and sell for any price dem want.

“Dem must comply wit our code of conduct because as regulator, na our duty protect di consumer and operators,” Saidu tok.

 Click here to save this Post as PDF
Let us connect on social media forever;
Keep in touc

Somtochukwublogng

Serving news and stories to the people of the Federal Republic of Nigeria.

Contents created by Taiwo Hammed.
Avatar
Keep in touc

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *